Sports Betting

Trending

random

Liverpool take Barca eye see red for inside Wembley

Liverpool beat Barcelona four kondo for the International Champions Cup wey shele for Wembley stadium on Saturday, August 6.

Jurgen Klopp boys do Messi and the rest anyhow for the match wen be say Barca nor even near their post.

Liverpool vs Barcelona

Sadio Mane dey celebrate one of the goals

PAY ATTENTION: Get the latest sports news on Naij Sports App

After the game, Liverpool star Adam Lallana talk say na the kind tonic wey him team need be this as the new season go soon start.

About 89,845 people wey come watch the match for stadium enjoy their time because Liverpool attackers wan finish Barca. Na Lallana first help Sadio Mane score the first goal when he stop Arda Turan short pass before Mascherano kon do own goal.

Divock Origi sef nak one beta goal inside net plus including a jolly jolly header by Marko Grujic header wey complete the match 4-0 for Liverpool.

“Our coachie don talk say make we no just dey allow Barca boys dey play us anyhow,” na Lallana talk this one after the game.

“He want make we dey attack out opponents too. Sometimes this thing hard especially if you dey play Barcelona, but the coachila say make we nor too give them space and na why we score them four.

“I happy say we win but we still get plenti things to do. Na just one week remain for us to train before we start the new season.

GET for FREE: Get the latest sports news on Naij Sports

The new EPL season go start next week and on Sunday, August 14, Liverpool go go Emirates stadium go face Arsenal.

The post Liverpool take Barca eye see red for inside Wembley appeared first on Nigeria News today & Breaking news | Read Naij.com 24/7.


Liverpool take Barca eye see red for inside Wembley Reviewed by Olusola Bodunde on 01:54 Rating: 5

No comments:

Thanks for reading, please share this post and leave a comment. Your comment is important to us

All Rights Reserved by Naija News Live © 2014 - 2015
Powered By Blogger, Designed by Sweetheme

Contact Form

Name

Email *

Message *

Powered by Blogger.